Everything (Amen) Lyrics
Everything(Amen) - Timi Dakolo
Composed by:Timi Dakolo
Everything you put your hand
Go work
Your Name go open doors
Amen
You sef go be a boss
Amen amen amen
Everything you put your hand
Go work
Your Name go open doors amen
You sef go be a boss
Amen amen amen
Every hustler get hin day day day
Wey the hustle go come
Dey pay pay pay
Your own e no go Tey
Amen amen amen
If you dey find work
Do your own oh oh
God sef go do hin own oh oh
And flesh go cover bone
Amen amen amen
If you believe it say amen
Amen
If you believe it say amen
Amen
If you believe it say amen
Amen amen amen
Everything you put your hand
Go work
Your Name go open doors
Amen
You sef go be a boss
Amen amen amen
Everything you put your hand
Go work
Your Name go open doors
Amen
You sef go be a boss
Amen amen amen
Sister wey want marry since
Since since
Aunty wey dey find Pikin
Kin kin
One day you go born twins
Amen amen amen
Tenant wey don lose hin job
Job job
Landlord come dey do like God
God God
One day you go be landlord
Amen amen amen
Good news go locate you
Amen
Watch and see e no go tey
Amen
If you believe it say amen
Amen amen amen
Everything you put your hand
Go work
Your Name go open doors
Amen
You sef go be a boss
Amen amen amen
Everything you put your hand
Go work
Your Name go open doors
Amen
You sef go be a boss
Amen amen amen
Long life go follow you
Amen
Strangers go favor you
Amen
Great men go honor you
Amen amen amen
One day you go sign the cheque amen
You sef go drive that Benz oh amen
This life go still make sense oh
Amen amen amen
Your children go make you proud amen
Bad people no go pull you down amen
One day you go run this town oh
Amen amen amen
You sef go spray me money amen
Baby go call you honey amen
You sef go host the party
Amen amen amen
Dangote go be your friend amen
Otedola go be your friend amen
Adenuga go be your guy
Amen amen amen
Elumelu go be your guy amen
Abdulsamad go be my guy amen
Rabiu go be my guy
Amen amen amen
Your life no go end in shame
Amen
Your business go bring you gain
Amen
If you believe it say amen
Amen amen amen
Amen amen
Amen